Na My Teacher Make Me Who I Be Today! By Ayodeji Tahir Olowolagba
Many dey talk say this life na jungle
And that if you dey reason am too much, your mind fit land you in troubles
Just like a bandit dem hold in chains
And like an untrained rider wey crashed and dey in pains
As aeroplane no fit fly without a pilot
And without teachers, the world for dey in chaos
Knowledge na light, knowledge na power
Without a teacher’s guide, person fit lost forever
My teacher na my role model wey shape up my personality
Na so e dey teach us lessons with good character and integrity
Moral values na the icing sugar on top the cake him dey serve
To be a good person like him, na so we all dey strive
Directionless, I for don be like a sailor wey no get compass
And like an unskilled labourer wey dey bid for contracts
But he makes my ambition smooth like fluid filling a keg through a funnel
Na so I jam green light at the end of the tunnel
I don waka go north, go south, go east, go west
Na those values dey always make me dey stand tall among the rest
All his efforts na debt someday I wish to repay
Cos na my teacher’s inspiration make me person wey I be today
This poem by Ayodeji Tahir Olowolagba emerged as a winning entry (top 10) in the Mrs. Felicia Ighoroje Memorial Celebration 2022 organised by PositiveNaija.
Ayodeji Tahir Olowolagba
Mr. Ayodeji Tahir Olowolagba graduated from the Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Nigeria with a Bachelor of Science degree in Education (Bsc. Ed. Physics) and also bagged a Masters degree in Radiation Protection (M.R.P) at the department of Physics (radiation and health physics unit) of the University of Ibadan.
He has over the years gained experience in the field of Radiation Protection and dosimetry, which include an internship at Secondary Standard Dosimetry Laboratory (SSDL) of Nigeria Nuclear Regulatory Authority (NNRA) situated at the National Institute of Radiation Protection and Research (NIRPR), Ibadan, Oyo State, Nigeria.
Mr. Ayodeji loves writing and he has participated in several online and offline competitions and has won many of them.