Recently updated on February 15th, 2022 at 04:47 am
How Love And Respect Take Important For Friendship Wey Get Head! By Ayodeji Tahir Olowolagba
Friendship wey get head
When a mirror got broken
The scars go still dey no matter how well dem fix am
Na so e dey be for a friendship
Wey small small betrayals don dey bend am
Life itself dey hard in its entirety
And nobody fit live in isolation
So we all need that person wey we fit confide in
Wey go give us solace anytime we get into tight situations
Na so our people dey talk am
Make una show me your friends
Make I take describe who you be
Because a ram wey follow dog stroll go surely chop shit one day
Many dey claim to be your friends
Purposely for wetin dem dey get from you
But as soon as you no fit afford their billings
Na so dem go quickly turn their backs and go dey badmouth you
Person wey plug you, person wey recommend you,
Person wey support you, wey dey genuinely proud of you
Ones wey love you, wey respect you, wey dey encourage you that you fit do anything!
Those ones na your real friends
And make u no dey quickly get carried away
Study every situations wella and make what flows flows and what crashed crashed
And no dey ever force anything in life,
Even if na conversation, love, attention relationship or friendship
Ayodeji Tahir Olowolagba
Mr. Ayodeji Tahir Olowolagba graduated from the Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Nigeria with a Bachelor of Science degree in Education (Bsc. Ed. Physics) and also bagged a Masters degree in Radiation Protection (M.R.P) at the department of Physics (radiation and health physics unit) of the University of Ibadan.
He has over the years gained experience in the field of Radiation Protection and dosimetry, which include an internship at Secondary Standard Dosimetry Laboratory (SSDL) of Nigeria Nuclear Regulatory Authority (NNRA) situated at the National Institute of Radiation Protection and Research (NIRPR), Ibadan, Oyo State, Nigeria.
Mr. Ayodeji loves writing and he has participated in several online and offline competitions and has won many of them.